The Devil’s Advocate

 

Yesterday, dem say my brother chop community money. Dem say the transformer money wey people contribute, e and e friends carry am enter restaurant, drink Hennessy, and snap pictures for Snapchat. I hear say dem even go club, pop champagne, and shout “Power ti de!” when the whole community never see light for 8 years now.

As for me, I don dey fight for justice since 1900. I no like cheating. Even when I dey primary school, I return change wey pass wetin dem send me. Justice na my middle name. But this case dey different because the person wey dem say chop the money na my own blood. My brother. My oga. My helper. My everything.

Abeg make I ask. If dem jail my brother, who go pay my house rent? Who go dey drop alert for my account every month? Na my brother pay for my wedding when I no get shishi. Na him give me the Toyota Corolla wey I dey use cruise babe. Even the work wey I dey do for National Assembly, na him fix me there. So make I now turn against am because of transformer? Transformer wey never even transform anything since?

Me and some other correct boys stand gidigba behind am. We tell the community say make dem calm down. We say na small misunderstanding. We say maybe na accounting error. Abi na crime to mistake millions for your own pocket?

But the community no gree. Dem shout, “Ole! Thief! Barawo!” One landlady even cry say her food business don spoil because fish seller no dey get light to freeze fish. One old man wey don dey charge torchlight for neighbouring town since 2017 nearly collapse. People dey vex say my brother betray the trust wey dem give am as landlord and Chairman of the Transformer Committee.

Some people dey shout say make EFCC come carry am. Some say make National Assembly remove am. Others dey demand refund or transformer by fire by force. But na so life be. Even devil dey get fans. If Lucifer fit get worshippers, who I be wey I no go support my own blood?

Me wey be Hallowed Chamber member, I dey use my position defend am every day. I go meeting dey shout “Point of Order!” anytime dem wan talk bad about am. Even if dem catch am red-handed with wire for hand, I go still say, “Let’s wait for Disciplinary Committee findings.” Because why? he make me Special Adviser on Chop Life and Vibes. You expect me to just forget loyalty because of one transformer wey never even on one bulb?

Sometimes I dey wonder. Na transformer dem dey find, or na revenge? Abi dem just dey jealous because my brother dey drive better car pass all of dem? Dem forget say leadership sweet but e bitter too. Nobody wan remember say na my brother carry the matter for head like gala before. Na when money enter, wahala start.

But as the matter long, the wahala no gree cool. Disciplinary Committee don dey summon person like NEPA wey wan cut light. My brother and him crew don dey dodge questions. Dem say make dem provide receipt. Dem bring faded paper wey look like assignment from 200 level.

Now everybody dey look National Assembly to decide. Dem dey wait make we remove am. Some of us dey shake because if we remove am, wetin go happen to us wey dey benefit? One of us whisper say, “If dem remove am, wetin I go chop?” Another one say, “Make we delay the report till exam time, everybody go forget.” But conscience na like bad belle, e dey always disturb you for midnight.

Last night, I look mirror. I see myself, fine boy, fresh, well-fed. But my eye red. Because deep down, I sabi say we dey do wrong. We dey cover corruption because we dey benefit. We dey chop the fruit of person betrayal and dey use am fry plantain for our own pot. And e get one thing wey truth dey do. e dey stubborn. Even if you hide am for pit, e go rise.

So this morning, I write my own statement. I no fit defend nonsense again. My brother help me, yes. But help wey come from stolen money no be help, na bribe. Na the same way politician dey dash people rice during election. And tomorrow, we go still complain say Nigeria no good.

Community deserve better. Even if na my twin brother carry money run, justice suppose dey blind. I no go be the devil wey wear suit dey justify evil. Transformer or no transformer, this fight no be just about light, na about doing the right thing.

And if dem remove am as Chairman, make I go hustle my own rent. Because I no fit sell my future because of free house and school fees.

Na so I carry my mouth confess. Make devil carry him advocate go find another court. For here, we don on the generator of truth.Light don finally show.